Tuesday, 10 October 2017

Dis NNPC gbege and de hand wen we Presido get for de matter





Baru and Kachukwu


PREMIUM TIMES done dig out de hand wen President Muhammadu Buhari get for inside de gbege wen dey shelle for Nigerian oil company, NNPC.
As many of una go done watch and read for we media, the number two oga for NNPC Ibe Kachukwu been write one letter wen get de date of August 30.
For inside dat letter, Kachukwu bad mouth de number 3 oga for NNPC, Maikanti Baru, say Mr. Baru dey carry shoulder high for am.
According to dat August 30 letter, wen Kachukwu been write; he accuse Baru say de number three man for NNPC, dey give people contract wen him (Kachukwu) nor know anything about.
Mr. Kachukwu come add for dat letter, say him decide to put the complaint for black and white because him don dey try tey tey; to talk to we Presido, Buhari but him no get luck speak to we baba.
Na till on Monday na him Mr. Baru come write him own side for inside de gbege, o.
For Inside Mr. Baru reply wen him write through NNPC talk talk person, Ndu Ughamadu; him talk say de bad mouth wen kachukwu dey give am na for nothing, o.
According to Mr. Baru, him say de laws wen concern contracts for NNPC no make am compulsory say Kachukwu must know about NNPC contracts wen come from him office.
According to the two letters; PREMIUM TIMES come discover say na because of de way wen Presido, Buhari take handle de matter na him cause de gbege.


President Buhari
The story follow say, wen Baru first start dey try make some changes for NNPC, Presido Buhari been dey sick dat time for abroad.
According to de story, Mr. Baru been tell acting Presido, Yemi Osinbajo; dat time, say make him approve de changes but Mr. Osinbajo nor gree. The acting Presido been tell Mr. Baru say lai lai; na until Kachukwu approve the changes na him Presidency go put hand, o!


V.P. Osinbajo


Instead make Mr. Baru carry de matter go meet Kachukwu, the story add say him no gree, o! na until wen Presido Buhari come back na him Mr. Baru come carry the issue give am. Presido come approve.
Na because of dat matter, na him make wen Mr. Baru come write dat letter, o.


No comments:

Post a Comment